* * \ * * ?> * Activity – Hameed Sodeeq – Otoariaverse
  • Profile picture of Hameed Sodeeq

    Hameed Sodeeq

    4 months ago

    Celebration everywhere after people hear say di World oldest professional footballer don join anoda club at di age of 57.

    Di 57-year-old former Yokohama striker wey im name na Kazuyoshi Miura don join Atletico Suzuka Club on loan from Yokohama FC and di club dey fourth divison for Japanese league.

    Yokohama FC bin send papa go loan for one Portuguese club wey dem dey call Oliveirense and papa don dey di club since last year February and since then e play 8 league games without scoring.

    Papa don decide to return to Japan na why Yokohama send am go Atletico Suzuka Club make e go help di club.

    Papa play hin first professional match in 1986 and e still dey play reach now.

    Abeg make una wish am well, for people wey dey find striker papa dey oo.

    Profile PhotoProfile PhotoProfile Photo +4 liked this
    7 Comments
User Balance 1,082 / OMBE

User Badges

Media

Friends

Profile Photo
Abiodun Adebisi
@adebisi19

Groups

resimaster

adepro

joyalum

adebayo