* * \ * * ?> * Activity – Hameed Sodeeq – Otoariaverse
  • Profile picture of Hameed Sodeeq

    Hameed Sodeeq

    3 months, 1 week ago

    Because today na Thursday make i throw una back to 1936 when one player career end at di age of 22 after e play against Chelsea.

    Jimmy Thorpe na better young goal-keeper and e dey keep for Sunderland infact di bobo don dey play first team football at di age of 19.

    In 1936, Chelsea vs Sunderland bin dey play ball, if Jimmy Thorpe carry ball for hand Chelsea players go dey kick am even for chest and di bobo still manage to finish di match.

    After di match, as Jimmy Thorpe just enter house naso di bobo collApse, dem rush am go hospital but e later kpai four days later and doctor say na d!abetes and he#rt failure follow kpai di bobo.🤦

    As di young promising talent kpai, dem come change rules say players no go dey carry legs up for goal-keeper anytime wey goal-keeper carry ball for hands.

    Profile PhotoProfile PhotoProfile Photo +4 liked this
    6 Comments
User Balance 1,082 / OMBE

User Badges

Media

Friends

Profile Photo
Abiodun Adebisi
@adebisi19

Groups

resimaster

adepro

joyalum

adebayo