-
FT scores: Chelsea 0 – 2 Man City
Man City don find Chelsea go Stamford bridge still collect three points and wetin vex Chelsea fans be say dem do am with clean-sheet.
As Kovacic score di second goal naso Todd Boehly use vex commot for stadium and if person see as e vex commot you go think say na better player e won go sign you no go know say e won enter Benin make e go sign anoda 2008 born talent.
Wetin dey do Chelsea be say dem no know where their problem di come from and that one na anoda problem if person no know where hin problem dey come from.
My people, Chelsea don start again this season and if dem continue like this dem fit follow Norwich and Derby County dey drAg first postion for Championship next season.
Abeg tag any Chelsea fan wey you know help me ask am whether e HBP don increase abi e decrease.
8 Comments
User Balance
309
/
OMBES
User Badges
Media
Photos
Videos
Audios
Files
Friends
Abiodun Adebisi
@adebisi19