* * \ * * ?> * Activity – Hameed Sodeeq – Otoariaverse
  • Profile picture of Hameed Sodeeq

    Hameed Sodeeq

    1 month, 1 week ago

    True true, life no be Nollywood, wetin you wish others fit back f!re to you.

    Oya make we tok about Jermaine Jenas di former QPR player and BBC show TV presenter wey just collect sack letter.

    • Jermaine Jenas na person wey dey criticize Erik Ten wella infact baba say make Man United sack Erik Ten because Ten Hag no fit lead Man United to di promise land.

    • Even when Man United win 2024 FA Cup oga Jermaine Jenas still tok say make Man United still sack Erik Ten Hag because Erik Ten no get pattern.

    • Earlier this week, Jermaine Jenas dey on air with TalkSport naso e come hear for news say BBC don sack am, dem allege say oga Jermaine Jenas go dey send one kind yeye messages to hin female colleague na why dem sack am.

    Person wey dey wish anoda person sack letter don first di person lose hin job so if you follow for people wey dey wish Rooney sack letter try repent ooo, e get why o.😄

    Profile PhotoProfile PhotoProfile Photo +4 liked this
    8 Comments
User Balance 249 / OMBES

User Badges

Media

Friends

Profile Photo
Abiodun Adebisi
@adebisi19

Groups

resimaster

adepro

joyalum

adebayo