* * \ * * ?> * Activity – Hameed Sodeeq – Otoariaverse
  • Profile picture of Hameed Sodeeq

    Hameed Sodeeq

    4 weeks, 1 day ago

    My people Saudi Arabia don put one player for national team trouble after Netherlands coach, oga Ronald Koeman banish Steven Bergwiijn from national team for joining Saudi League at 26 years old. According to the tory, na immediately Ajax confirm say Bergwijn don join Al-Ittihad for Saudi naim Koeman remove him name from Netherlands squad. When dem ask am why, the former Barcelona coachie reply say: how I no go remove him name? Small boy wey dey just 26 years wey decide to join Saudi Retirement League, shay da wan be like player wey get ambition? Saudi na for players wey don dey get romantism and arthritis because of old age. 40-years old players like Ronaldo wey dem career don finish sotay dem no fit score single goal for Euros, na dem dey play Saudi. No be small boy wey never achieve anything, you carry yourself go dump for Saudi dey train with mechanic and danfo drivers like say football pitch na motorpark. If you join Saudi League for your prime that means you no serious for your career again. And I no fit dey invite player wey no serious for him career come my national team. As Bergwijn don decide to end him career for Saudi, me sef I go help am end am well well back home for Netherlands. As him don decide to sacrifice him future for Arab Money, I go make sure say na only that money him go dey enjoy. Because right now, I don cancel him name from the book of life and I don close him chapter. It’s over!

    My people shay dis thing wey Koeman do Bergwijn make sense abi the matter no suppose serious like that?

    Profile PhotoProfile PhotoProfile Photo +5 liked this
    8 Comments
User Balance 90 / OMBES

User Badges

Media

Friends

Profile Photo
Abiodun Adebisi
@adebisi19

Groups

resimaster

adepro

joyalum

adebayo