* * \ * * ?> * Activity – Hameed Sodeeq – Otoariaverse
  • Profile picture of Hameed Sodeeq

    Hameed Sodeeq

    5 days, 10 hours ago

    My people no be small beef don dey shele between Arteta and him mentor, Pep Guardiola as we don dey hear now say Giardiola dey provoke and para on top Arteta head. Una remember say after their 2-2 draw last weekend wey City players begin complain say Arsenal use voodoo and juju and dark arts take nearly win the match, Arteta reply them say; una better mind the way una dey talk to me abi una don forget say I get all una update? I dey with una for that Manchester City for 4 good years so I know all of una own dark arts and dark secrets too.

    Na diswan don make Guardiola come outside with anger and provocation dey tackle Arteta say; wetin you mean by that? Which update be that? If you get anything to talk come outside and talk am with your full chest, stop going through the corners. Because Man City dey face 1000 count cases for court wey we know nothing about. And FA say those things happen when you dey here, so if na you do those things you better come outside and confess. Because I no understand why you this boy wey I train you for 4 years, wey na me even allow you go become Arsenal coachie because City oga them no want make we allow you go join our rivals because you know our club well well. I even support your ministry with some important players like Gabriel Jesus and Zinchenko. Yet you don dey cap nonsense against me. You don dey betray me like Judas. You see why e no good to dey help some people for this life? All the good wey I do for Arteta and him family, see as him dey repay me? Shay e good like that?

    My people una don see the gbege as e dey shele between father and son. Abeg wetin una see for this matter?

    Profile PhotoProfile PhotoProfile Photo +4 liked this
    6 Comments
User Balance 90 / OMBES

User Badges

Media

Friends

Profile Photo
Abiodun Adebisi
@adebisi19

Groups

resimaster

adepro

joyalum

adebayo