* * \ * * ?> * Activity – Hameed Sodeeq – Otoariaverse
  • Profile picture of Hameed Sodeeq

    Hameed Sodeeq

    5 hours, 39 minutes ago

    We don dey hear now say many Super Eagles players don dey frown dey squeeze face unto why Eguavoen go invite Benjamin Tanimu wey dey play for England Division 3 to join dem for Super Eagles squad wey go play Libya. Benjamin na defender wey dey play for Crawley Town inside England League 2. To make matters worse, him never even play one minute for that Craw-craw Town wey him dey. Na diswan don make some players and staff come outside dey shake head say diswan na big fock up for a whole Super Eagles say where big names dey like Victor Osimhen, Ademola Lookman, Victor Boniface, Troost-Ekong, then we come add player from Division 3 join dem. Some of the staff even talk say Benjamin no different from Bobrisky because him self get one godfather wey be one big politician wey dey dash NFF money well well. The only way NFF fit pay am back na to dey invite him boy come national team. In fact na Finidi be the first coach to invite Benji to Super Eagles when him still dey play for Tanzania league. The guy connection strong sotay Finidi bench Awaziem to play Benji. Na after that invite and feature naim Crawley Town go sign am from Tanzania league.

    My people over to you. Shay e make sense to dey invite player from Craw-craw FC to dey join Super Eagles abi make dem carry players from our own league instead?

    Profile PhotoProfile PhotoProfile Photo +2 liked this
    5 Comments
User Balance 486 / OMBES

User Badges

Media

Friends

Profile Photo
Abiodun Adebisi
@adebisi19

Groups

resimaster

adepro

joyalum

adebayo