* * \ * * ?> * Activity – Hameed Sodeeq – Otoariaverse
  • Profile picture of Hameed Sodeeq

    Hameed Sodeeq

    2 hours, 43 minutes ago

    Some footballers dey get injury during match, others dey get injury during training. Others even dey get injury during warm up. But the kind injury wey former Manchester United star defender, Axel Tuanzebe get, me I never hear da kind one before. According to the tory, Tuanzebe wey currently dey play for Ipswich say make him enter kitchen go wash plate after nearly one week wey him never wash plate for house. Na where bros dey wash plate naim one big glass break, fall and tear the bros hand even open the vein. According to the doctor them for hospital, the thing deep like wetin aboki use suya knife take cut and if to say dem rush am go roadside chemist instead of hospital, by now the bros for don lose him fingers. But as e be now, dem don stitch the hand and the vein but e go tay before Tuanzebe go return back to action. Na diswan don make many people dey wonder why Tuanzebe no remove small from all the money wey him dey make go pay house girl wey go help am dey wash plate both inside kitchen and elsewhere.

    Anyway, my people how una see dis kind injury wey this former Manchester United star boy go collect so?

    Profile PhotoProfile PhotoProfile Photo +1 liked this
    2 Comments
User Balance 489 / OMBES

User Badges

Media

Friends

Profile Photo
Abiodun Adebisi
@adebisi19

Groups

resimaster

adepro

joyalum

adebayo