* * \ * * ?> * Activity – Hameed Sodeeq – Otoariaverse
  • Profile picture of Hameed Sodeeq

    Hameed Sodeeq

    2 hours, 47 minutes ago

    Former Barcelona defender, Gerard Pique don come outside dey complain about him former wife Shakira say; abeg make una help me beg Shakira to leave me alone because I no know wetin I do her for this life. Shebi na she break up with me after 11 years and 2 children together. She kick me out of our house. She even begin spread rumor say I cheat on her with one smallie even though she know say I no really cheat on her. She even compose new music wey she go insult me inside, dey call me Voldemort. No wahala. Now I don get new girlfriend and Shakira no wan gree me and my new girlfriend rest. Say na child abuse I dey do because I use 12 years take senior her. But she forget say she sef use 10 years take senior me so na child abuse she dey do me too. Now wey my eyes finally clear and I don go find new baby wey be young blood wey go give me young kpekus, e don dey pain her. She don even dey insult my babe say she dey follow her papa mate like say she sef no be my mama mate. Abeg make una tell Shakira to leave me alone make I enjoy my life with my new babe.

    My people how una see this complain wey Pique drop against Shakira so?

    Profile PhotoProfile PhotoProfile Photo +1 liked this
    5 Comments
User Balance 1,082 / OMBE

User Badges

Media

Friends

Profile Photo
Abiodun Adebisi
@adebisi19

Groups

resimaster

adepro

joyalum

adebayo