* * \ * * ?> * Activity – Hameed Sodeeq – Otoariaverse
  • Profile picture of Hameed Sodeeq

    Hameed Sodeeq

    1 month, 1 week ago

    Victor Osimhen de collect €11m( 11.9 b!llion naira) every year for Napoli and di bobo won add small thing for hin salary some people dey vex say e go kpai hin career if e no reduce e salary.

    If to say you know how Victor Osimhen take carry pure water dey pursue bus for ojota before e see money buy football boot you go know say Victor Osimhen deserve di money.😄

    If you know di kind shege wey Victor Osimhen see before e make am through football you go even tell am make e increase hin salary x3.

    Jude Ighalo don tok am before say dem no dey play football for passion again and na true because some of our legends wey play football for passion don enter street back some dey sell herbal mixture now.

    CAF player of di year deserve better and e deserve better salary.

    📷: Victor Boniface

    Profile PhotoProfile PhotoProfile Photo +4 liked this
    7 Comments
User Balance 158 / OMBES

User Badges

Media

Friends

Profile Photo
Abiodun Adebisi
@adebisi19

Groups

resimaster

adepro

joyalum

adebayo