-
Breaking: Ghanaians don begin dey buy eyeglass wey dem go use find their two players wey japa for USA.
One Ghanaian club wey dem dey call Asante Kotoko SC bin travel go USA make dem go play one competition and dem suppose play match with DC United today.
As dem enter USA, two of their players from Sudan wey dem call Esmat AbdalHamid Mohamed and Obdoelkarem Yoouef Yagoub come tell officials say dem won go buy something for outside.
Naso di two players take japa with their passp0rts , uptill now dem never come back, if dem chat them for WhatsApp dem go block dem,if you call them , dem no go gree pick calls.
Officials don report to Police make dem help them find their two players so incase you dey USA and you see two boys wey get dada abeg help us report to Police, we dey find them.
3 Comments
User Balance
678
/
OMBES
User Badges
Media
Photos
Videos
Audios
Files
Friends
Abiodun Adebisi
@adebisi19